Monday 28 September 2015

FINALLY IT ENDS..... AND THE WINNER IS...

So that is how it happened o, that 18-year old Jeffery Ufedo Akoh, Nigerian, joined the list of exceptional Superstars that have won the most Celebrated Musical reality show in sub Saharan Africa, and joins the list of Superstars to watch out for.

Monday 21 September 2015

FINAL LAP, HOME STRETCH... BRING ON THE VOTES!!!

ahem,

I de greet o, how una dey?

Hope say u a dey enjoy o, hope sa everything dey okay?

Ehen, I bin just de pass o, I say make I remind una, all the campaign and all the voting, all the running around, all the shouting, all the singing, all the academy things, e go end this weekend. This weekend!

Saturday 19 September 2015

INTERNATIONAL CLASSICS...... HOW UNA DEY?

My People, 


I de greet una o, e been don tey small, i just say make i hail una. shey una de follo the show as e dey go so, abi na because say dem no de send anybody go house again, na wetin make una stop to de follow the show? 

Thursday 17 September 2015

SUPERSTAR COLLABORATION UPDATE: WHICH SUPERSTAR + WHICH CONTESTANT?

#HURRYING OUT OF THE OFFICE*
#NARROWLY AVOIDS A MOVING DANFO BUS*
#EXCITED*

Ehen, my people, shey I bin tell una that time say I hear say the project fame contestants go dey do collaborations with some Nigerian music superstars ,and una no believe me.

Wednesday 16 September 2015

CLASSICAL WEEKEND DON LAND, HOPE SAY UNA DEY VOTE O!

make una no ask me how and where I from get the list of songs for the week. this project fame don de end, I bin dey busy de vote, na my friend copy am for me from you tube,





CLASSICS WEEKEND (INTERNATIONAL) FRIDAY

Saturday 12 September 2015

AND HERE COME THE FINALISTS! WHO WENT HOME?

Ehen, my beautiful people, I de throway salute for una.
How una dey na?
Shey una fine? And everything dey fine?
How una wife dem? And una pikin dem?
Okay. Na wetin we de pray for be that.
Una de enjoy this my tatafo work wey I de do for una so?
E for no bad if una de try to at least de drop small small comments, make I de know say 
una de feel am.

Okay, how we wan take talk this one?
The eviction show……e come get as e take happen o, no be as una think.





Thursday 10 September 2015

GUESS WHO'S COMING THIS REGGAE WEEKEND?


Ahem, I de greet una o, wetin dey na?
I hear one gist o, say Geoffrey, that brother wey win Mtn Project Fame Season 7, say e dey come this weekend, say e de come do album launching, shey na true?