Monday 21 September 2015

FINAL LAP, HOME STRETCH... BRING ON THE VOTES!!!

ahem,

I de greet o, how una dey?

Hope say u a dey enjoy o, hope sa everything dey okay?

Ehen, I bin just de pass o, I say make I remind una, all the campaign and all the voting, all the running around, all the shouting, all the singing, all the academy things, e go end this weekend. This weekend!


And me don dey vote since, but this week, na double double o, na to use all my power and energy, and almost all my money, begin de vote. Nothing go shake my vote this week, my vote go yapa, e go boku, e go heap, all of them. My candidate must to win, by force by fire, and by vote. If una like, make una dey there de dull una selves, the way I de use vote this week ehn, na all body o, no time for to de hear sorry say my contestant no win am.
So who be una own contestant? Una get? Una de show am love so? The love wey I de talk no be by to de post him picture for facebook and twitter o, no be that one rara. The love wey I de talk n to de spend the money de cast the votes, because apart from vote, every other thing na “arabanco”, that is to say, no be anything.  Make una vote, in fact, make una no vote sef, because the more una decide not to vote, the more e dey sure for me say my own contestant go win, and win very well. So if una like, make una no vote. No wahala, my contestant go win.


Ehen, in other news, shey una hear say the contestants dem don de do major collaborations with some artistes dem, the thing don de show small small o!

I see am for live show, say PEARL and CHIDIMMA, wey bin win Season#3, say dem dey studio together, de sing one song together, I hear say na the remix of “kedike”, that song wey blow anyhow that time, wey be say the song dey everybody mouth, everybody dey sing am, na the song wey she dey remix with Pearl. Ah, but pearl get luck o.

Also, I see am again, for the live show, say YEMI ALADE, that girl wey sing JOHNNY, say she de remix one of her song dem with JEFF, say dem dey remix “K.I.S.S.I.N.G”,  that sweet song, ah, me sef I like the song die, na wetin make me just de reason say the boy get luck up and down, say e get luck scatter.

Na now I wan enter the main sweet tori, I see am for twitter say AREWA de snap picture with 9ICE, that Bros that time, wey sing “Gongo Aso”, say two of them de remix the song. Kai! See level! See luck! That song, wey be say everybody de sing am that time, wey be say the song de turn closing of party to beginning of another  party, chai, the song hit that time ehn, hit anyhow, everybody just de sing am, na the song wey Arewa de follow 9ice de remix, chai!

Another one wey I see for twitter na ANDERSON, that tall yellow boy for the Academy, where e de snap picture with COBHAMS and PRAIZ, say dem de do remix of “RICH AND FAMOUS”, that song wey Praiz take dey very popular, wey be say the song blow anyhow like knockout for Christmas, ah, Anderson don hammer, hammer anyhow, see luck and level for him side, and imagine say the boy bin don go house before o, if no be say people shout, say thr boy no go fit go like that. the boy own don better.

AH, the news don leak for twitter, say Ada dey follow SOUND SULTAN, that bros wey be say na legend, wey be say e sabi sing well well, wey sing many many song dem wey popular, wey be say we know am well well, say she de follow am sing remix of MOTHERLAND, wey be say sound sultan sing about somebody wey travel go abroad, ah, the song go make sense finish. the girl get luck. 

Okay o, una don see am, who una feel say the remaining person go do song with? Na DEINDE remain o, as dem tak say KUMI no well, say she dey hospital. Make we de look, make we de see as e go be.


Make un de vote o, na una hand e dey, if una know say una wan make una favourite contestant win this thing, make una vote, me sef don de vote. I de hail una. 

No comments:

Post a Comment