Saturday 19 September 2015

INTERNATIONAL CLASSICS...... HOW UNA DEY?

My People, 


I de greet una o, e been don tey small, i just say make i hail una. shey una de follo the show as e dey go so, abi na because say dem no de send anybody go house again, na wetin make una stop to de follow the show? 


Okay, news dey. Shey una sabi say this week na international classic songs dem sing? ah, if say una see the show, una for de clap for the judges and faculty, but most especially the faculty. If you see the way all these contestants de sing, de perform, you go believe the work wey dem de do. As the week dem de pass, the contestants dem just be like onions, wey be say if you open one, another one go dey inside. 
                 Ah, wo, this one no be play, next year, make God keep me, I go come that project fame audition, and I go try my possible best, make me sef enter, make I for be superstar. Kai!   Imagine all the superstars wey these people dem don meet, just say dem dey inside academy. People wey be say we de see them for tv, na so these boys and girls dem go just de see them, de relax with them, de play with them…

Wait o, wait o, as I just dey here de dream of as my next year go be, make we no go forget the matter o, hope say una still de vote? I go live show, I just see people wey wear t-shirt, with different different contestants names on top, both those wey don go house, and those wey still dey for academy. Me, I bin wan do t-shirt,  with the name of my own special contestant on top the t-shirt, but I just reason am, reason am well well, I just use the money take buy recharge card, take do some mega voting. So next week,

When I come the show, na ordinary cloth I go wear, but I go de smile, say I don sink better money inside the voting matter. One of the contestants na my special person, but that one no concern una, na make una de vote una own be the koko. If I go tell una my own special contestant, wahal go  dey inside the matter:

Una go say I don vote well well, if say na the same contestant we get, and una no go vote again, other people go come sabi who I de support, come begin de spend money on top voting, then my own person go come lose, so e better if I no tell una, make una just de vote.
 


E go be later.


No comments:

Post a Comment