Ehen,
my beautiful people, I de throway salute for una.
How
una dey na?
Shey
una fine? And everything dey fine?
How
una wife dem? And una pikin dem?
Okay.
Na wetin we de pray for be that.
Una
de enjoy this my tatafo work wey I de do for una so?
E
for no bad if una de try to at least de drop small small comments, make I de
know say
una de feel am.
Okay,
how we wan take talk this one?
The
eviction show……e come get as e take happen o, no be as una think.

Geoffrey, na him do digital launch of the album. Mehn, the guy de sing
o!
The
guy sing like four songs, na so the contestants come join am on top stage where
e de sing, and them join am sing the special song wey e compose for Mtn Foundation. if una de find the song to download, make una go www.geoffreyoji.com, enough information dey there.
Na
so show come finally start, dem march all the contestants come out on top
stage, all the contestants just stand de shake, dem just de look. Na so Bibie
Brew, that fine Ghanaian woman wey sabi sing like no man’s business, wey be one
of the judges, just look them, say she wan make special announcement.
NO
MORE EVICTION!!!!!!!!
NA
FINAL SEVEN WE GO GET THIS YEAR!!!!!!!!!!
All
the contestants dem just begin de happy, de smile, de laugh, like people wey
dem dash money.
All
that stress of who and who person go vote, and who person go save, and who
person go eliminate…
All
those ones don end.
Na
to come see who go get the maximum votes, wey go make am be the winner, carry
N5m, plus new SUV, and record deal.
Una
still de look?
Begin de vote na, wetin you de wait for?
Ehen,
lest I forget, UGOVINNA & EMEKUS also perform for the show o. una still
remember them so?
Ugovinna,
na him sing “RAIN ON ME” see him picture here
And Emekus, na him sing “BOJOM” see him
picture here sef.
In
case una forget, by this time last year, na Ugovinna, Emekus, and Geoffrey dem
dey inside the house, de beg for una votes, to keep dem for the competition, and now
this year, dem don be star. Oya begin vote, by this time next year, na your own
candidate of choice go be the STAR!
Begin
de vote.
E
go be later.
No comments:
Post a Comment