Ahem, I de greet una o, wetin dey na?
I hear one gist o, say Geoffrey, that brother wey win Mtn
Project Fame Season 7, say e dey come this weekend, say e de come do album launching,
shey na true?
Wey be say na the very place wey the musical career for take
start properly, and the guy de come back there, come salute the people wey make
am blow, become superstar.
If na true, then e make sense die.
Because na so life suppose be, when pikin de do well, e no
go de shame to come house, because Papa and Mama sef go de get sweet mind to de
see am, dem go de happy say their pikin no de miss road.
Una remember Geoffrey
so? Wait, in case una no remember, in case say una don de look the fine fine
faces of #Tejiri, #Joy, and #Oluchi, plus all the #Richie and #Biko dem, and
una don forget the face, see am here,
and in case e no still ring
bell for una head, na him sing “Bursting My Brain” and many other beta beta
song dem.
I even hear say some other Project Fame Alumni go dey there gidigba to support am as e dey do the launching. #Oshey!

I even hear say some other Project Fame Alumni go dey there gidigba to support am as e dey do the launching. #Oshey!
Na to just try, take excuse from work, tell My Oga say I no
well, say belle de disturb me, make I for get chance to go that album launching something. Enough igbedu!
That song de burst my brain!
Ehen, make we no forget the matter wey still dey on ground
sha, Geoffrey don win him own, na last year own be that, but
who wan win this year own?
Who you de support?
Na by mouth?
You no go vote?
See, make I advise you, that money wey una wan take print
T-shirt, and cap, use am buy credit, de vote, because na wetin me sef do. The person
wey I de support… well, that one na my business, who wan ask me make e ask me
for inbox, no be here we go de talk all those ones.
Meanwhile...
This week na Reggae Week, and I don get the list of the songs dem!!!
Reggae
Trench Town Rock. .. Bob Marley.. .. Pearl
Murder She Wrote. .. Chaka Demus and Pliers.. ..Jeff
Electric Avenue. ..Eddy Grant.. ..Deinde
So Long. .. Majek Fashek.. ..Arewa
What's Gwan. .. Ras Kimono.. ..Ada
Back to My Roots. .. Lucky Dube.. ..Kumi
It Wasn't Me. .. Shaggy.. ..Anderson
Meanwhile...
This week na Reggae Week, and I don get the list of the songs dem!!!
Reggae
Trench Town Rock. .. Bob Marley.. .. Pearl
Murder She Wrote. .. Chaka Demus and Pliers.. ..Jeff
Electric Avenue. ..Eddy Grant.. ..Deinde
So Long. .. Majek Fashek.. ..Arewa
What's Gwan. .. Ras Kimono.. ..Ada
Back to My Roots. .. Lucky Dube.. ..Kumi
It Wasn't Me. .. Shaggy.. ..Anderson
I de come, make I go buy more credit, the one wey me sef buy
don finish.
E go be later.
No comments:
Post a Comment