Tuesday 25 August 2015

NAIJA WEEK........... NAIJA WEAK!

Ehen,
*looks round to be sure*
*adjusts chair*


My people,

Una hear wetin happen for Project Fame?
Naija week turn to Naija Weak


Ada sing "Ragga Ragga" by SHEYI SHAY.   (1)

Anderson sing. "You No Holy Pass" by 2 BABA.  .(2)

Arewa sing "Ojuelegba" by WIZKID.  (3)

Biko sing "No Stars" by. DAREY ART ALADE.  (4)

Chike sing "Mr Oreo" by IYANYA.  (5)

Deinde sing "Jaiye Ori Mi " by BANKY W.  (7)

Jeff sing "Godwin" by KOREDE BELLO.  (11)

Joy sing "German Juice" by CYNTHIA MORGAN. (13)

Kumi sing "Eyo" by ASA. (14)

Oluchi sing "Jamb Question" by SIMI.  (19)

Pearl sing "Awwww" by DI'JA.  (16)

And after all the singi-singi and danci danci.......


All of them enter probation

True to God, I no go lie you, all of them enter.
Weda na vex the judges take do am o, sake of say the contestants be like say them plan the voting that day, I no just sabi, wetin me know na say......
All of them dey probation, so make una begin de vote with ONLY una MTN line, and na dem number dey up there, in brackets.

Which contestant una wan make we discuss him matter next?

Oya drop comment here make I see,
We go jam later na.
Area!

1 comment: