*****fanning self seriously*****
****puts fan down to type****
*** adjusts laptop screen***
**flexes fingers**
*yawns*
my people,make una no vex for me o, una know say amebo no be work, say e get another thing wey I dey do to take dey make my daily puff-puff,
when my hand no reach bread, so na wetin I bin dey do since, na wetin make me no carry gist come for una. Make una no vex abeg, life no be canival.
Wetin de happen, wetin de shelle, wetin be the happening Gist? I don manage bring una the list of songs wey una BABIES dem, the CONTESTANTS for Project Fame, dey sing this weekend, shey una remember say last week, after the contestants do their own finish, say the Judges nack all of them Probation, so this week, see the song wey dem go de sing.
Before we see the list of song dem, make we remember say na who una vote for na him go stay o, since na all of dem dey probation, but sha, in addition to the probation songs dem, see the list of contestants plus the songs wey dem go de sing this weekend.
Oluchi Take a Bow Madonna
Jeff If You're Not The One Daniel Bedingfield
Chike Say You , Say Me Lionel Richie
Anderson Story Of My Life One Direction
Joy Because Of You Kelly Clarkson
Deinde As Long As You Love Me Backstreet Boys
Pearl Blank Space Taylor Swift
Arewa Try Sleeping With a Broken Heart Alicia Keys
Kumi From This Moment Shania Twain
Biko Ordinary People John Legend
Ada That's The Way It Is Celine Dion
Okay, my people, una sabi the songs na, the songs popular well well, make una begin choose, dem go fit sing the songs well?
Deadline go soon reach, na #3Oclock be the time wey voting go stop. Oya begin dey vote!
My Oga don de call me, we go jam later, no forget to drop comment o!
I don #gerrarahia. #Issokay
No comments:
Post a Comment