Saturday 29 August 2015

ELIMINATION SHOW.......OH MY.......COULD IT BE TRUE?

***slouches into the room***
***drops bag on the bed***
***slumps***
***sad***



Ah.
My people, if una see wetin happen for show today, kai, una go follow me de cry as i de cry.
Show start, ad them line up the contestants wey get the lowest votes, make dem come out come sing to save themselves. Na so dem line up ......


JEFF,
KUMI,o Judges
JOY,
BIKO, and
ANDERSON.

Na so five of them come sing, sing finish, e come reach to begin save people. Na so Judges save ....
KUMI
As I de look with my eye wey swell up like fish own, na so Faculty save...
JEFF
By this time, shit don de catch me, and I no gree get up, sake of say make I no go miss the show.
Na so the contestants dem wey dey safe, wey get enough votes begin vote, as them check the vote finish, na ...
JOY dem save.

CHOI!!!!!!!!!!!!!!!!!

BIKO, ANDERSON, about to leave????

Na so I open mouth like fish inside water, with the kind surprise wey hold me. Biko and Anderson, going home?


Abeg, make una no vex, I no get power talk this night, I just weak anyhow.


Abeg, this Project Fame no gree me watch again, I don weak.

If I pass that side again, I no go even look, or check wetin de happen.

Una Good night.

No comments:

Post a Comment