Monday 31 August 2015

A TALE OF TWO FEELINGS............. GUESS WHO CAME BACK!!!!!

****hurrying into the room****
****carelessly peeling off socks and shoes****
****grabs tab from bed where it was charging****



Ahhhhh!!!!
My people, I happy no be small, in fact, the way body take de sweet me, e dey do me like say make I begin dance azonto, etigi, and shoki, all at the same time. 

ANDERSON DON COME BACK!


The thing surprise everybody. You remember say I tell una say as dem commot the Anderson guy, say belle no just sweet me, abi? make i no lie, i don delete the application wey I bin download for my phone to take de check the CCTV cameras dem, but as I ask my friend wey go the live show, cos me I no even go, na so the thing pain me reach, no be say I get special likeness for the guy o, but for my eye, the guy na one of the guys wey true true sabi sing, so e bin no suppose go, na so the thing just be.

         Back to the matter wey I bin de talk, as my friend wey go live show tell me, them just de do show small small, na so brother Josef and Sista Bolanle just ask weda the people dem like surprise, na so them talk yes, na so the screen just change, dem show Anderson for hotel, show am where e commot from the room come outside , na so e see the  Judges.  Dem just tell am say as them shine eye take “oju surukun” look the matter again, and as them look the guy performance over the weeks, plus the way e take commot, na so dem say make dem give am another chance...

             Na so the whole place scatter, people just de halla, de shout, de throway voice, me ma no even know say people like Anderson reach like that. Na so the guy just commot from somewhere enter stage, na so everybody just de shout, de halla, de scream, and the guy sing  “Story  Of My Life” by One Direction, and people just de happy, de jollificate. 
  
                Even the contestants sef wey dey for back, my friend tell me sef say them just de halla, but shey una sabi say this thing na competition, and if one person go, e go make things easier for the others because people wey de drag the prize don reduce, but the kind of  shout wey the contestants dem de shout, I no come sabi again whether na shout of happiness or shout of sadness, because as Anderson don come back so, e sure say the thing go tough well well again.

In other news, all the contestants don enter probation, and even as dem de claim happy, de form overjoyed, by weekend,  one or two, or even three people go commot from the house.
 In other-other news, I don re-download the application wey I bin de use take de from corner de look the cameras dem, de check tins wey de happen inside house. I go continue to de show una the latest news and things. Oya, make una go vote. If una no vote now, anybody wey commot from house, na una do am. So no be by to de click like for facebook and de make noise for twitter. Whoever go commot from the Academy next, na una do am, the small pikin play don end, now na real serious business.


I hail una o, invite your friends dem make dem come look as you sef de look.

Issoryt!



No comments:

Post a Comment