An Insider's look at the ins and outs of Project Fame West Africa. Exclusive photos, videos, and all sorts of stuff you won't see anywhere else!
Sunday, 23 August 2015
ELIMINATION SHOW 2: AS E TAKE HAPPEN, OR HOW IT WENT DOWN
PLENTY THINGS DEY HAPPEN O, MY PEOPLE,
Na wah o, my people, shey una see wetin happen for this weekend show so?
No be small thing o. This Project fame sef, the thing wey de happen inside, no be one person mouth go talk am finish. For the last elimination show, six people bin dey probation:
Richie, Tejiri, Deinde, Oluchi, Ruby (Pearl's twin sister) and Chike.
So, when all the contestants don sing their songs finish, na so the ogbonge judges them siddon gidigba, say dem wan decide as the matter go be
Bros Josef Benjamin con bring the list, check am for paper, say na _Chike_ be the contestant with the highest number of votes, so therefore, Chike don dey safe
*****One safe, five still in danger *****
The ogbonge Judges dem, Ade Bantu, Bibie Brew, and Tee Y Mix, come siddon together,
say na Oluchi dem wan save! Na so all the contestants wey remain begin de talk small
small, de shake, de shiver.
*****Two safe, four still in danger *****
Na so e reach the final one, dem say make contestants wey no de probation choose the. Person wey dem go save.
Ehen, by this time, make una remember say na Richie, Deinde, Tejiri, and Ruby na dem remain wey nobody don save o, because na here the gbege start to de happen. Na so the contestants begin vote.
Richie : 2 Votes
Tejiri: 2 Votes
Deinde: 2 Votes
Ruby: 2 Votes
Ah! Wahala!
Na so the judges dem reason the matter well well, say make them call the person wey fans save from voting. Na so dem go call Chike come.
Upon say the harmattan (the one wey oyibo dey call air condition) wey dey inside the studio
de cold anyhow, wey people siddon like meat inside freezer, Chike de sweat, him voice de shake, like say e catch fever, abi na fever catch am.
The judges come tell am say na him go choose the person wey him go save. Chike look left, e look right, e look up, e look down.
E wan tell the judges say e no de choose, because anybody wey e choose, na the three wey remain, na dem go commot for the Academy begin de go their house dem.
Na so Chike look dem face finish, e choose Deinde. Na so Deinde take de safe be that o, if not..... E for don de near him house, or even to don reach by now.
Tejiri, Richie, and Ruby come sing the song wey dem bin suppose sing for naija night, Chai! See singing, see dance, See performance!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
lols... thumbs up @theadmin
ReplyDelete