Saturday 8 August 2015

FIRST TIME IN HISTORY!!!!!!!! EJIMA INSIDE ACADEMY ?



Eheeeen, my people, how una dey? 

Meeeehn, if una helep me see wetin happen for Project fame live show yesterday,   the thing go taya you as e take taya me sef. 

Na so we dey o, inside Project Fame show, de watch the contestants dem dey sing, na so dem say dem wan call the people wey bin no make am, wey dem say make dem do another song put for Youtube, say na Wildcard audition, na so the girls dem waka enter.
Me sef I shock , when I see dem. Na so I put ear for ground, begin hear, e come be say out of the three girls, the tallest one… she sing die! The girl na even ejima sef, naim be the one wey scatter my head, the girl na the ejima of PEARL wey dey inside the Academy. The girl na RUBY, PEARL sister.

The other girl na Oluchi, and the girl sabi sing gaaaan! She sef sing, sing so tey people commot cap keep  one side where dem de look as the girl de sing.


Na so the girl sing finish, the last girl come sing, the last girl sef sing no be small, In fact, some people say she sing pass some of the people wey first enter  Academy, but as she sing finish, e just be like say the angel wey follow those other two girls senior her own angel, sake of say because the song no move people as the first two people own take move people. Na so the judges begin de reason the matter, dem reason am, reason am reason am, so tey dem taya, dem take break, come drink water, go outside, go pour spit, scratch head, and all the other place dem wey fit scratch person, na him dem finally carry microphone, say since wey dem come project fame start to de judge, dem never see this kind of a something  before, say the girls dem too sabi sing, and the choosing of only one person no go let them,  say if them choose one, say e go be like say na bad thing dem do the other one, and if them choose the other one, e go still be like say na bad thing dem do. So last last, dem cross mind, say lai-lai to lai-lai, say two of them  go must to enter the Academy.
Crowd shout, crowd scatter, see as everywhere just de boil like egusi soup on top stove, but the last-last thing be say na two girls enter the Academy last night. Make una no vex for me, I de for house right now, when I reach where I keep my laptop  I go upload the two girls picture dem.
Oya make un tell me , how una take see the matter of ejima inside Academy? Dem go gang up, begin show the others pepper, abi dem go by dem self dey quarrel?

Abeg, drop comment here, make we discuss the matter.


Make I take style dodge small. E go be later.


1 comment: