An Insider's look at the ins and outs of Project Fame West Africa. Exclusive photos, videos, and all sorts of stuff you won't see anywhere else!
Tuesday, 4 August 2015
SO UNA SAY UNO NO SABI WHERE UNA GO DE WATCH AM FROM, ABI?
*peers at screen of android smartphone*
*presses phone a few times*
*opens laptop and restores from hibernation*
My people, my people,
How far na?
How the hustle de go?
Shey Nepa and associated issues de still de allow una de relax small small?
The reason why I like Project Fame pass any other reality show........
Because e dey free and safe for the whole family to watch, nothing like all those music videos wey we de see for television, wey go make person papa de pursue am if actor and him babe don de look each other one kind eye.
erm, people de shout my name for Facebook, for Twitter, and for all other social media dem, say dem no sabi the time wey Project Fame de show for TV, well, I just say make I check am online make I come tell una, make e no be like say na only me de enjoy the show for TV.
Oya, take paper, take biro, make una copy the things wey I wan talk now.
From Monday to Friday, una go fit de watch Project Fame for the following stations dem:
TVC: 6:30 pm- 7:00 pm
SoundCity 7:30 pm- 8:00 pm
OnTv 8:30 pm- 9:00 pm
GET TV 9:00 pm- 10:00 pm
NTA 10:00 pm- 11:00 pm (only on Fridays O!)
On Saturday, make una ready for enough flexing and igbadun, because una go fit watch two separate shows! Oya take down the time here:
SHOW ONE SHOW TWO
TVC: 2:00 pm- 3:00 pm 6:00 pm- 7:00 pm
SoundCity ----------- 7:30 pm- 8:30 pm
OnTv ----------- 8:30 pm- 9:30 pm
GET TV 9:00 am- 10:00 am 9:00 pm- 10:00 pm
NTA 2:00 pm- 3:00 pm ---------------
Oya, for Sunday, come take down the time here:
TVC 5:30 pm- 7:00 pm
SoundCity 7:30 pm- 9:00 pm
OnTv 8:30 pm- 10:00 pm
GET TV 9:00 pm- 10:30 pm
NTA 4:00 pm- 5:30 pm
MAKE I GO SLEEP....................
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment