Saturday 5 September 2015

One Blow, Thr33 Evicted.... Chei!

****rushing into the room****
****locking the door****
****picking up phone****
****typing****

Ah, my people, if una see wetin happen for The last project fame live show ehn, e go taya una as e take taya me.

Imagine say I dey corner as usual de watch as the show de go, na so show start o, all the contestants come out for stage, begin de sing Fela song, first na Arewa lead them, as dem de sing “Water E No Get Enemy
na so the four boys sef dance enter front, begin sing “She go Say I be Lady
next thing, yellow bobo Anderson enter centre, begin sing “Yellow Fever
before , as dem de sing that one finish, Jeff land front of the rest begin sing “Zombie


Okay, show come true true start. The contestants wey get the lowest votes, na so Brother Joe begin call out their names

AREWA
CHIKE
JOY
KUMI
OLUCHI
PEARL


Na so the other contestants wey dey safe go one corner go siddon. Na so the six contestants begin sing, and the crowd just de appreciate, de halla their favorite contestant, de shout.
Last last, all the contestants dem sing finish, e come reach the critical point, where the saving go start from, all of them stand front of judges on top stage.

Judges save………   Arewa
Faculty save ……..   Pearl.
 Contestants wey de safe, wey no go probation vote………..    Nobody.

Wahala dey o.
Anderson and Ada vote KUMI
Deinde and Jeff   vote  CHIKE

Equal-equal, the one wey oyibo dem de call tie.
Na so dem say make dem count the votes, make dem check the contestant with the highest votes, make the person come be the tie- breaker.

Na so dem check the scores, na ………… ADA.

As dem call the Ada sef, she de shake, she de struggle to waka, e be like say piss de catch am. She waka come, dem say make she vote one out of the two. Na so she vote……..

KUMI.

SO na so Oluchi, Chike, and his lady love, Joy, take commot from the show, in just  one show.
I sad small. But the show must to continue.

My people, we go align later. I go keep una posted.
In other news, I hear say Brymo de come the show come perform, abeg na true?

Oya drop ya comment, make we relate. 

No comments:

Post a Comment