Thursday 3 September 2015

Ehen!!!!!!! E don Shele, E don Happen!!!!!

****rushing in excitedly****
****looking left and right****
****whipping out phone****

My people,
I de hail o, how una dey na?
Wait, wait, no rush me, the gist wey I get for una , e big, e heavy, e strong kakaraka.


Shey I bin tell una say na me be the fly wey de perch for wall, de hide for corner?
Ehen, I get one special gist for una, make  I show una say na me still current pass,
Shey una still de vote for una favourite contestants?
Okay o, make una dey vote o, make una hand no slack o, me sef don de vote since, but I no go tell you who I de vote, afterall, na me be amebo, abi?
Okay, make we siddon, make we yarn.
Shey una see that Academy?  Things dey happen inside. I know say all of una sabi the small small way wey  some contestants  de take de like dem selves, but the news wey I de hear now be say…

…this year, some of the contestants go start their musical career in a big way, because dem go begin dey do …

COLLABO!!!
Yes o, na so I hear am,  say some contestants go begin de collabo with some  beta beta naija music superstars, de sing better jamz for us.
But make I no lie, e still depend on … Una votes.
Una know why?
Simple!
Who una vote for, e go stay, and if collabo time reach, e go join do the collabo, but if e no dey, that is to say, if una no vote for am, no matter as the contestant good reach, if una no vote, e go go house
Shikena!
So this one now na warning sign for me, for you, and for all of us, make we go vote!

Make I run go buy recharge card, this voting, man no go dull himself.
E go be later.
Who una feel say be the musicians wey go come do the collabo songs?
Oya drop ya comment. 

1 comment: